Wetin Come Be The Diffrence Between Cho Cho And Unripe Paw Paw By Zlatan (Fan View) - 9jaflaver





Light Dark

WELCOME TO 9JAFLAVER

PREMIUM BEATS  |  NEWS  |  SOCCER LIVE-SCORE   |  MOVIES   |  +18 ADULT LEAKS   |   INSTALL 9JAFLAVER MUSIC APP   |  HOTTEST 100 SONGS  |  SPORTS  |  CELEBRITY GIST  |  MIXTAPE  |  JOKES  |  LATEST COMEDY VIDEOS  |  NIGERIAN MUSIC ARTISTES  |  






9jaflaver advert



Wetin Come Be The Diffrence Between Cho Cho And Unripe Paw Paw By Zlatan (Fan View)



Wetin Come Be The Diffrence Between Cho Cho And Aki And Paw Paw By Zlatan (Fan View)

Omo i wake up in the morning as per correct guy wey i be after hangover. No blame me o! na DJ i be, the one wey una dey call disk jocker for English language.

The party wey dem host me make i come carry the DJ work dem nearly kee me with shayo. The shayo for the party plenty sotey me sef forget wetin i dey play but everybody still dey vibe ontop. No looseguarding o men plenty asin Ikorodu bois dem display dat night but nothin spoil since e b say na enjoyment party for one guy wey pick. Guys for street don tey wey dem even see show like dat sef since e b say lockdown don spoil many tins for ground so we gats just use the party hold body.

Before i show for the party, me don arrange Amapiano type of song like dem “Phyno – Highway” “Falz – Squander” “Focalistic And Davido Ke Star” and the rest. Na the kind of vibe wey dey ground now-na wetin dey give street joy!. Producers ma sef join for the wave as per say na wetin dey trend. My playlist don ready and i know say since na me be one of the best DJ for Area, everywhere go fit scatter. I ready keep sef. This one now na by the way o. this one na wetin happen yesterday as i no fit remember most things now. I fee say hangover still hold me keep sef. But as e be ehh make i enter the real thing wey carry me send this mail.

I wan talk about Zlatan Ibile, i wan talk about him kind of music, i wan even talk about how him and OBO ( I mean thirtybeegee boss o) dey take takeover street with jam within 24hours. I dey wonder how dem dey take do am.

E never tey wey him drop Lagos Anthem, me sef dey thing say the guy go pipe low enjoy the work wey e don do until i open my browser say make i update my playlist with latest song na im i jam Cho Cho wey e feature DMW boss Davido and Mayorkun, i come dey wonder which kind tune e wan give us since wey na Amapiano dey reign. Me know say Zlatan na Zanku boss and e no go wan leave him kaba.

As i say make i download am here am, e come turn out say this song carry one kind ginger wey be say i never see before. One kind thing wey another artist no go do before just like that. but i know say my ear no go deceive me nah. i don hear something like this from Kapajumarejupako master before. I search Unripe Paw Paw abi Aki and Paw Paw wey him feature Jamo Pyper and Oberz inside make i hear am. Mehn dis guy sabi o. This guy fit turn water to wine for this him Zanku pattern o.

Na similar type of song my man give us but this time around e follow the Chorus Pattern for Unripe Paw paw give us Cho Cho wey e feature Davido and mayorkun. I no no weda na the hangover still dey worry me o but i feel say na the Same type of chorus vibe na im him give us for both. Na the way wey him use the energy for the both na im dey surprise me o.

The promotion wey follow the song sef no be here o, i just dey scroll through all my social media handle including blogs na Cho Cho dey trend since. As per DJ wey i be, my next mix gats be Cho Cho 2021 mix sef. Make I go do one or two but i say make i drop my opinion here make una see.

I go happy say una share am to una users 9jaflaver.

Mail sent from: djmoefriday@gmail.com








Promote Article, Music, Video, Comedy Skit & Virals
Call: +2348143945195 Or +2349027283345

Whatsapp: +2348143945195




















2 Comments

  1. Anonymous says:

    Cho cho na pure street vibe

  2. Abu+sneh says:

    Trash song

Comment Below:-

Enter Name Below (Optional)

         
Enter Comment Below:-


ATTENTION!! CAN'T FIND THE SONG YOU ARE LOOKING FOR? INSTALL 9JAFLAVER GO APP NOW TO GET ALL MUSIC, STREAM AND DOWNLOAD LEGALLY, AND LET YOUR FAVOURITE ARTISTS GET PAID ROYALTIES (CLICK HERE)




Promoted Songs





DMCA.com Protection Status

© 2014-2023 9jaflaver. All Rights Reserved.


About us | DMCA | Privacy Policy | Contact us

| Advertise| Request For Music | Terms Of Service


9jaflaver is not responsible for the content of external sites.