Asake Dey Deal With Afro Amapiano Beat O! (Dont Hype Me) Don Comot!! (Fan View) - 9jaflaver





Light Dark

WELCOME TO 9JAFLAVER

PREMIUM BEATS  |  NEWS  |  SOCCER LIVE-SCORE   |  MOVIES   |  +18 ADULT LEAKS   |   INSTALL 9JAFLAVER MUSIC APP   |  HOTTEST 100 SONGS  |  SPORTS  |  CELEBRITY GIST  |  MIXTAPE  |  JOKES  |  LATEST COMEDY VIDEOS  |  NIGERIAN MUSIC ARTISTES  |  






9jaflaver advert



Asake Dey Deal With Afro Amapiano Beat O! (Dont Hype Me) Don Comot!! (Fan View)



Just recently i say make i run some check on latest jam wey dey online na im i come across one music Mr Money. No Vex o, the song na last year 2020 dem release am after the corona virus lockdown wey sweep men comot for dem feet.

As I download the song, I wonder which kind vibe this guy use, e no even stress him sef just as Star Boy “No Stress” song dey. The guy just use the Amapiano beat scatter everywhere for mah head. I wonder which kind cool artist be this wey people never hear of sef. Later on na im I come start dey see some of him song for some mixtapes wey i download such as DJ SJS mix and others.

Even the song sef come get remix with Zlatan and ThirtybeeGee artist Peruzzi o. That Peruzzi side give me joy no be small o. Zlatan carry him own street vibe come too.




Me don become Asake fan already from that day on wey i listen to him jam. As per e get as d industry be na, artist sometimes no dey too release jam just like that anyhow. so i gats dey wait for another one by this guy. As I dey wait, other song wey carry amapiano vibe begin to trend as artist start dey jump on am. U no go blame dem na, producers no get choice dan to join the moving trend. Phyno O, Masterkraft O, Falz O, Davido O, all of dem run tinz with dis Amapiano trend o.

E bin say i too don wait o, na im i see new jam wey comot wey DJ Xclusive feature am and Young Jonn. My Belle sweet me, omoh i rush download am immediately, my expectation na 100% and he no dissapoint, the Amapiano beat mad join, the follow up na die, bros my love for the song no be here, na so Gegeti just dey my mouth for nearly one week straight. My neighbours sef don dey vex because my sony sound system na blast!! but since na 9ja we dey, man gats mind him business o.




U knw as e dey be na, we dey always ask for more like the days of when Pepsi Ask For More dey trend for under canter bottle. I relax dey wait for new release, naso my bro just drop anoda one this time only am again wey him titled Dont Hype ME. Lolz Jooor Joor Jooor Dont hype me Joor. I no go talk much o!! Go stream am or you download am make you hear am too!!




This fan view was written and sent to 9jaflaver by Ikechukwu J. O.








Promote Article, Music, Video, Comedy Skit & Virals
Call: +2348143945195 Or +2349027283345

Whatsapp: +2348143945195




















1 Comment

  1. its king Vado M ley says:

    Am feel song

Comment Below:-

Enter Name Below (Optional)

         
Enter Comment Below:-


ATTENTION!! CAN'T FIND THE SONG YOU ARE LOOKING FOR? INSTALL 9JAFLAVER GO APP NOW TO GET ALL MUSIC, STREAM AND DOWNLOAD LEGALLY, AND LET YOUR FAVOURITE ARTISTS GET PAID ROYALTIES (CLICK HERE)




Promoted Songs





DMCA.com Protection Status

© 2014-2023 9jaflaver. All Rights Reserved.


About us | DMCA | Privacy Policy | Contact us

| Advertise| Request For Music | Terms Of Service


9jaflaver is not responsible for the content of external sites.