BBC has gone ahead to reach out to the Bayelsa State government to clear the air and below was their finding.
Bayelsa State goment say no need for confusion as to who be di face of Bayelsa Girl child.
Dis one na as di Governor, Douye Diri honour di double first class graduate in law, Ms Ebizi Blessing Eradiri as di new face of Bayelsa Girl Child after im bin don also give former Big Brother Naija housemate Nengi Hampson di same honour.
Di Governor also give Nengi and di oda BBNAIJA housemate from Bayelsa, Trickytee appointment as Senior Special Assistants to di Governor for November 2020.
Nengi and Trikytee of BBNaija don become senior special assistant for Bayelsa State
But as pipo dey wonder wetin Ms Eradiri appointment be and for di BBN reality star, Chief Press Secretary to di Bayelsa State Governor, Daniel Alabrah tell BBC Pidgin say di goment never comot Nengi as di face of Bayelsa Girl Child as di goment fit give as many pipo as possible any title dem wan give depending on di sector dem wan emphasise.
“Nengi dey for di entertainment sector so she fit function for dat aspect, while Ms. Ebizi Eradiri dey for di education side. All na for dem to inspire and encourage girls for di state say dem fit become better in dia aspirations. E no good make pipo dey speculate or politicise evritin.”
Alabrah observe say many pipo bin dey tok wen di governor bin recognise Nengi last year say im neglect Ms. Eradiri wey get first class but add say evri sector get potential and advantage and na for di goment to look into ways dem fit encourage pipo for dia different areas.
Meanwhile, Nengi don congratulate Ebizi Blessing Eradiri on her appointment as di new face of Bayelsa Girl Child come say dem go work togeda to bring better welfare for di girl child for di State.
Source:- BBC
SPONSORED LINKS
SPONSORED LINKS
Sell Your Bitcoin And Gift Cards Now, Get Paid Instantly (Click Here)
For Website Design, Management And Free SEO Support (CLICK HERE)
For music and Commercial video Animation , Music and Commercial video shoots Business Branding etc. Contact anklyn (Click Here)
Learn LOCAL And CONTINENTAL DISHES online from the comfort of your home For 2,000 naira only. (Get in here)
Music Artistes!! Buy Exclusive Beats With Complete Data, Wav, And License ON 9jaflaverstore [Click Here]
Music Artistes!! You Can Now Buy Hit Songs From SOUND MAGIX SONG WRITERS (Click Here)
Professional Music/Artist Art Work For 3,000 Naira (Click Here)
© 2014-2021 9jaflaver. All Rights Reserved.
About us||Content Remova||Privacy Policy|Contact us
Advertis|Request For Music
9jaflaver is not responsible for the content of external sites.