"Why I Danced Hold-Tight With Obasanjo" - 'Patience Jonathan'(By Sahara Reporters) - 9jaflaver





Light Dark

WELCOME TO 9JAFLAVER

PREMIUM BEATS  |  NEWS  |  SOCCER LIVE-SCORE   |  MOVIES   |  +18 ADULT LEAKS   |   INSTALL 9JAFLAVER MUSIC APP   |  HOTTEST 100 SONGS  |  SPORTS  |  CELEBRITY GIST  |  MIXTAPE  |  JOKES  |  LATEST COMEDY VIDEOS  |  NIGERIAN MUSIC ARTISTES  |  







Get New DJ Mixes



“Why I Danced Hold-Tight With Obasanjo” – ‘Patience Jonathan'(By Sahara Reporters)



“Why I Danced Hold-Tight With Obasanjo” – ‘Patience Jonathan'(By Sahara Reporters)

“Why I Danced Hold-Tight With Obasanjo” – Patience Jonathan
Hello, this is Jebose. Can I help you?Eh, Jebose, na who you dey yarn Amerikana for. You nor sabi my namba again. Oloshi. Hehehe. My mommy. The mommy of all mommies.
Gerraautt. Who be your mommy. Your mama dey for una Onicha Ugbo grave. I beg nor mommy me.
Mommyyyy… you mellow this morning o. Hope nothing dey pa?.How far mommy. This one wey you call me so for early mor mor
Sharraap. You nor happy I call you?. I hia say you rite buku say Waiting for my hosbans to die. Na which womans dey wait for im hosbans to peme?. Na wa for you and dat buku. You go sell so?
Haba madam. How you take don hia nah… I be wan ask make you waka come be Chief Launcher na! But you jus comot word for my mouth
Dat your smelly smelly maut. You dey aks me who tells me. You forget say I be fes lady. I dey hia eferythins about my friends
Eyyaaahh!!! So I be your friend. You come leave me go waka dey dance with baba Iyabo. Na wa o, madam. You fall my hand sha. Friends don’t let friends dance with retired Presidents na.
Jebose if I slap you?. Idiot. I say you be nonsense pikins. Scaliwag like you. Make me I dance with you?. Church rat of Onicha Ugbo. Hmmm. It is not your folt o. I swear. Na me carry my Etisalat begin call your yeye China made Nokia flipu fone. Alakoba
Madam the tin wey pain me be say you come dey hold baba iyabo tight sef for dance floor. I beg where Oga Jonathan dey wey you dey tap agbalagba current?
Oloriburuku omo ale. If i hole am nkor. Na only me waka come nah. Jebose, wetin konsan you if i dance hole tait with Daddi Iyabo. I say wetin konsan you. You nor be my hosbans. Or you be my boi frens?.Mscheeww.. which kain korent you say I tabu… baba nor get korent o.
Eh. Madam cool down nah. Make I talk my own. Body just dey pain me. How old man go dey gbadun you like dat and I dey hia dey dream and provoke.
Jelosi don kee Jebose. I go report you to Alhaja. Daleru. You wan scatter my hause. I beg wetin you get. Wai I go dance with you?. You wey be Common reporter. You nor get agbara reach baba OBJ. You nor be former presidence of Naija two timeses. One wey be soja boy and the other be civilian presidence wey we waka enter democrasi. You nor get money. You nor sabi plenty peoples. You nor get korneshion… Common buy recharge card for your yeye Glo line, you nor get money for recharge. Your fine gel pikin still dey drink SMA made in Alaba. Make you hia nau. Baba Iyabo na im get Naija. Na only him fit tell EFCC make dem free me and my hosbans Jonathan. Baba Iyabo be power and privilege. You na jus gbeborun. So anyhow baba want, I go dash am. If your bodi dey pain you, go aks your papa PMB make im give you APC melesine. See as una dabaru Nigeria since your papa come with jibiti shange. I beg Jebose, levu don shange. Free me. Let me be. Daddi Iyabo be my latest bes frens. If you like you can go and die. I nor send you.

Hia… mommy so na so you go take do me. Remember sha, no condition is permanent o. I fit be President tomorrow
Hehehehehehe…makeuna see Jebose O… Egba mi O. You, be President tomorrow?. Make you sidon dia dey wait for tomorrow nah. Your own kondishion na pamanence becos since I sabi you, you never shange: You still dey live for that your foolish face me, I face you room and parlor for Mushin, dey que for 4a.m in the morin to go poo and baff becos na only one toilet and baffroom dey for the face me I face you hause. And you don live for the same hause since I sabi you. So your own kondishion dey pamanence…

Madam, God dey O. All this dance you are sharing, Dia is Allah O
Which Allah? Omashe o. So Alhaja don konvashion you to Muslim?. Eyyaahh. Your own don finish. No wonder I see dat foto wey you be like Almajiri for Kano. No wonder you dey follow PMB.

You see unaself?. Pesin nor see pentro. Nigerians dey sofa. Your broda, Kachikwu wey dem put in charge of our oyel say im nor be majishan… Nigerians nor get eletriciti to charge fone. Pentro nor dey to enjoi life ni ile wa. God don ponish una wey comot my hosban. Una don see shange nah. Very soon una go begin see credit. I beg I wan call Daddi Iyabo make I see where the nest parry dey so I go dance with am. Jebose, comot for my fone, I beg. Gerraaauutt. CLICK.

Azuka Jebose







Get New DJ Mixes



Promote Article, Music, Video, Comedy Skit & Virals
Call: +2348143945195 Or +2349027283345

Whatsapp: +2348143945195























DMCA.com Protection Status

© 2014-2023 9jaflaver. All Rights Reserved.


About us | DMCA | Privacy Policy | Contact us

| Advertise| Request For Music | Terms Of Service


9jaflaver is not responsible for the content of external sites.